Erigga – “Wahala” ft. Oga Network

Erigga Oga Network Wahala

Erigga and Oga Network releases “WAHALA” music video directed by DINDU.

South South rapper, Erigga teams up with songwriter and storyteller Oga Network to deliver this thoughtful record titled “Wahala“.

Today Paperboi drops the official music video for this track which is off his 2020 EP- Before The Chaos.

Enjoy!

LYRICS

Wahala deyWahala full here oCountry wey blind man dey count moneyWahala deyWahala deyWahala full here oArmed robber dey call thief oleWahala dey

Oga DPO na who thief him phone for inside police station, abegNepa office on generator dem no no wen light go come

As I dey follow you dey talk all my men don offThe loud wey we dey smoke dem no fit drag pass one puffWe taya for Nigeria matter I no fit lie youNa wetin Fela and China talk still dey happenWho rule go waste money work he no go doHustle don make boys forget wetin den read for school12 years 13 years don dey do YahooDey look Epa wen nor dey do like big MaluEpa don graduate for Ekpoma but no levelHe find work he tire he kukuma join HKAccording to am the rain wey beat am today, go wash im Benz tomorrow once e puma payFor all the good men he dey jam no wan get shishiI no fit judge d story don pass deeper life preachingSince Jona no get patience he join takingNa last week dem poof close to that bakery

Wahala deyWahala full here oCountry wey blind man dey count moneyWahala deyWahala deyWahala full here oArmed robber dey call thief ole oWahala dey

Oga DPO na who thief him phone for inside police station wahalaNepa office on generator, dem no no wen light go come(how dem wan take know)

Dear Abacha small thing fit reach meThe last one you send come area we no see shishiStay at home but where the electricityNigeria na cruise I swear God forbid bad thing

Wetin dey occur my whatsApp na MandilasView my status na shoe, bag, hair and slippers15years no dey sleep house she don enter streetDey sell pussy for Lekki her Father against that shit

Cos na she dey survive dem alert steadyThis generation don cast wen e go endingNa Yahoo money make Aunty collect big slap cos 17years don too dey my snapNigeria now be like fowl wey no get ownerWho swear give us e no go better for unaCovid 19 grandchildren wey suppose give us cureDon turn makeup artiste dey director pure

Wahala deyWahala full here oCountry wey blind man dey count moneyWahala deyWahala deyWahala full here oArmed robber dey call thief ole oWahala dey

Oga DPO na who thief his phone for inside police station very bigi wahala o e dey hereNepa office on generator, dem no know wen light go comewahala dey here oo

[follow]

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *